WARRI BIG BABE WEY DEM DO INTRODUCTION FOR LAST MONTH DON LEGGO FOR RUNS WAKA

Loading

Information reaching Voice of Warri be say one young lady wey her name na Favour, don leggo this morning for aççid£nt as she dey travel from Ondo state back to warri.

According to reports, Favour just do introduction last month and her wedding don set for next year March. But despite all the love and plans, Favour still carry her old lifestyle for head.

Her close friend reveal say Favour na hookup babe normally, and na during one of her waka for one hotel for Niger Cat she meet the man wey later engage her.

Favour promise to stop the runs life, begin go church, baptise and talk say she don give her life to Christ — but e be like say all na eye service.

Favour tell her man say she dey go Eku go visit her sister wey dey sick and go spend some days with her, but na Ondo State she actually enter — go do one d00ĝÿ mission with client wey book her for 5 star hotel.

Sadly, as she dey return from Ondo after her latest d00ĝÿ ministration, accident happen and she kpuff instantly.

May her soul rest in peace.

Source: Voice Of Warri